From di return of HBO zombie apocalypse thriller to Michelle Williams for one provocative new role.
1. The Bondsman
Inside dis droll new series, Kevin Bacon add demon-chasing bounty-hunter for im long list of horror characters.
Hub Halloran na bounty hunter bifor im murder, but wen im land on di oda side, di devil imsef give am second chance redemption, reanimate am and send am back among di living to track down and return demon wey don escape hell.
Di catch: if im fail for im job e go return into di flames forever. For im downtime from hunting demons – they have piercing yellow pupils, the better to identify them – e try to settle wit im family.
Na Blumhouse produce di Bondsman, di company wey dey behind such hit horror franchises as Di Purge, so reason dem to believe in dis show wit cockeyed premise, wey manage to throw in country music.
Di Bondsman go premier on 3 April on Amazon Prime internationally
2. Pulse
Netflix dey contribute to di endless stream of soapy medical dramas wit dis series wey be about students and residents for Miami trauma hospital. At di centre na Danielle (Willa Fitzgerald) wey dem appoint as chief resident wen di previous chief – suspend her ex, Xander (Colin Woodell).
But wait! Wahala dey, so Xander no comot for di hospital and togada dem resolve dia personal issues wey dey between dem while saving lives. Justina Machado (One Day at a Time) play dia boss, di Chair of Emergency Medicine.
Di terrific Max series Di Pitt don prove how well dis genre fit work, and di show go drop dia season finale, so Pulse fit fill di gap. Just dey prepared for evergreen lines like, "Im go code!" and, "If you go one millimetre too far, she go die!"
Pulse go premier on 3 April on Netflix internationally.
3. Dying for Sex
One of Michelle Williams best performances na her character as Gwen Verdon in di television series Fosse/Verdon, and here she take on another rich small-screen role as Molly, one woman wey dem diagnose wit Stage IV breast cancer, she decide to spend her last months on no-holds-barred journey to indulge herself sexually while she still get time.
Jenny Slate plays Nikki, her best friend and wingperson. Di series na base on di Wondery podcast wey Nikki Boyer create about her friend Molly Kochan, di real-life inspiration for di show. Jay Duplass play im role as Molly husband, Sissy Spacek na her mother and Rob Delaney na neighbour for di series, comedy dey inside di drama.-
Critics don make comment about Williams and di show, di Observer tok say "di series' comedy neva strike wrong note", and The Daily Beast call am "near perfect amalgamation of absurdity and tragedy".
Dying for Sex premieres on 4 April on Hulu in di US and Disney+ in di UK and internationally
4. The Handmaid's Tale
Some shows get cultural impact of The Handmaid's Tale. Women protestors for real life don march in red cloaks, referencing to di handmaids in di series' misogynistic state of Gilead and symbolising oppression.
Di show plot don long since outrun di Margaret Atwood novel wey dem use write am, and in dis sixth and final season June (Elisabeth Moss), escape to freedom for Canada, im run comot and continue to fight wit di resistance.
Di most chilling characters return, wit Ann Dowd as Aunt Lydia, Yvonne Strahovski as Serena and Bradley Whitford as Commander Lawrence. Dis final season go offer "feel-good episodes", di series showrunner, Yahlin Chang, tell TV Insider. For one recent panel conversation di creators also tok about dis season landing for one political climate wey make pipo shock: "We need to meet dis moment," Whitford tok. "Our women no be Marvel characters, dem be ordinary women wey dey do extraordinary things," executive producer Warren Littlefield add, e declare say di show final message na "di war is neva end, but di fight continue".
The Handmaid's Tale go premier on 8 April on Hulu in di US
5. Hacks
Jean Smart fans love her for her Emmy-winning role as Deborah Vance, di old-school stand-up comic wey revive her career wit di help of her young writer and frenemy, Ava (Hannah Einbinder).
As di fourth season dey start, Deborah don realise her dream of hosting late-night talk show, only to face di ambitious Ava, she wan blackmail her way into becoming di head writer.
Di relationship betwin Deborah and Ava – sometimes mentor-mentee, sometimes competitors, sometimes loving and always troubled – na di heart of di series, but di success rest largely on Smart perfectly acerbic delivery.
Julianne Nicholson dey among di season guest stars in di show wey dey use comedy to address big issues including sexism and aging in di entertainment industry.
Hacks go premier on 10 April on Max
6. Black Mirror
Since Charlie Brooker dystopian sci-fi series start for 2011, di real world don increasingly caught up to di show, wit di mainstream use of artificial intelligence.
Di seventh season of di anthology include, unusual sequel. E return to USS Callister, di show classic Star Trek homage, wit Cristin Milioti (The Penguin) as computer programmer wey find herself clone inside one video game. "Normally I kill off characters at di end of one episode, [but] I keep some of dem alive.
I still dey grow as human," Brooker tok. Di oda five episodes feature popular faces, as fans dey expect. Dem include Awkwafina, Paul Giamatti, Emma Corrin, Will Poulter, Peter Capaldi, Issa Rae, Chris O'Dowd, Tracee Ellis Ross and Rashida Jones.
Text in di trailer show di word, "Lose Your Mind. Lose Your Reality." Let's hope dis words no go harm us for real life, but den Brooker always dey one step ahead.
Black Mirror premier on 10 April on Netflix internationally
7. Your Friends and Neighbors
Jon Hamm don get some great, attention-getting supporting roles since Mad Men, including di bullying, corrupt sheriff for im most recent season of Fargo and di slick gazillionaire in di Morning Show.
But once again na di main character for dis comic drama about Andrew Cooper, wey pipo sabi as Coop, one rich hedge-fund manager wey lose im job and see im privileged life and identity slipping away.
Struggling to keep up appearances and support im ex-wife and dia teenaged children, start to stealing jewels, designer bags and oda valuables from im friends.
Amanda Peet play im ex-wife, she leave am for one of im best friends, and Olivia Munn na im on-and-off fling.Na novelist and screenwriter Jonathan Tropper create di show (This is Where I Leave You).
Craig Gillespie (I, Tonya) direct di first two episodes of dis vibrant series, di good news be say dem don already order for second season.
Your Friends and Neighbors go premier on 11 April on Apple TV+ internationally
8. The Last of Us
One of di best, most gripping shows of recent years don return for di second season of pipo wey dey try to survive zombie apocalypse.
Di story pick up five years afta di previous season end, but Joel – Pedro Pascal for im breakthrough role – and Ellie (Bella Ramsey) dey create new dynamic.
Dat na just one change. Dem go create new variant of di infected creatures, smarter and more lethal dan di old breed. Kaitlyn Dever (Apple Cider Vinegar) join di cast as soldier Abby, don already dey cause too much online tok becos Dever dey physically slighter dan di character wey dey di video game series, dey base on.
And Catherine O'Hara take on dramatic role as Joel therapist, becos who no go need one afta everything e don go through? Pascal, dey give Joel fierce energy, e tell Empire magazine say di new season "further tests our strength against di world we dey afraid to be in".
The Last of Us go premier on 13 April on HBO in di US and Sky Atlantic in di UK.
9. Government Cheese
David Oyelowo, wey pipo last see on television as 19th-Century US Marshal in Lawman: Bass Reeves, head to di 20th Century for dis comedy and redemption story set in 1969 California.
E play di role Hampton Chambers, wey dem just release from prison wia e dey serve im time for burglary.
E dey determined to regain di confidence of im wife and two grown sons, and change di family fortunes by inventing self-sharpening drill wey dem dey call Bit Magician.
Govment cheese refer to di bricks of processed cheese di US govment once distribute to pipo wey qualify for food assistance.
Hampton spiritual quest, tell Variety im character get "dis weird interaction wit God, wia e get direct relationship to di point whereby miracles, di type wey dey for Bible, dey manifest for im life".
Government Cheese go premier on 16 April on Apple TV+ internationally
10. Andor
Di much-anticipated second season of dis prequel to di film Rogue One: A Star Wars Story (2016) conclude di backstory of Cassian Andor (Diego Luna), and im journey from scrappy thief to fighter for di Rebel Alliance, and di heroic figure wey im be for di feem.
Di many movie spin-off series on Disney+ get im up and down, but e get wide agreement say Andor na one of di best. For representative view, Vulture headline for di first season review say, "Andor na di Cure for Star Wars Ennui", and den dem call am "di most challenging and invigorating work in dis galaxy in years".
Tony Gilroy, di series' creator, return for di final go-round, along wit cast wey include Stellan Skarsgård, Ben Mendelsohn, Forest Whitaker and plenti of Stormtroopers.
Disney+ don give di new season big, confident push by making di first available on Hulu and YouTube.
Andor premier on 22 April in di US and 23 April in di UK on Disney+
11. Étoile
Amy Sherman-Palladino don create two wildly popular shows, Gilmore Girls and Di Marvelous Mrs. Maisel.
But her latest echoes her lesser-known, wonderful Bunheads (2012), wit Sutton Foster as Las Vegas showgirl turn small-town ballet teacher. Dat show only last one season, but some fans don embraced dem.
Étoile na comic drama wit bigger dance-world canvas, as ballet companies for New York and Paris decide to trade dia star dancers in effort to support di flagging institutions.
Charlotte Gainsbourg play di role of head of di Paris company and Luke Kirby (Lenny Bruce in Mrs. Maisel) di head of the New York troupe.
Di cast also include Simon Callow and Lou de Laâge, along wit dancers from di New York City Ballet and Boston Ballet. As always, Sherman-Palladino show promise both comic mayhem and sharp dialogue.
Étoile go premier on 24 April on Amazon Prime internationally